Wednesday 1 December 2021

Squid Game Naija

Squid Game Naija 
by Seun Lari-Williams

Green light, red light. 
Where you for see light?
If to sey money dey am, 
maybe we for tink am.
But for Squid Game Naija,
na for only our life we dey play.

Start.

Obi Chikolobi 
Obi out! 
(But Obi for no die if to sey 
doctor dem no dey on strike). 
Ada chikalada
Ada bang!
(Container fall on top Ada
for Ojuelegba).
Tinko Tinko 
tinkoloko Tinko.
We no see uncle Tanko again, 
as we no get money for ransom.

Farmers, form a big circle
at the back of your homes. 
Now, who is in the garden? 
Ten chubby, graceful cows.
Boju Boju, o! O! 
Now open your eyes.
After round one, 
one hundred farmers shot
in the head.

On 20/10
youths played Ten Ten. 
Several raised the wrong leg.
All of them dead
(Accidental discharge by
Ungun knownmen). 

Pikin sef dey play o. 
Like police wey dey find thief,
pikin sef must find
mama and papa wey 
fit give dem food chop -
before dem even born dem.
No be me go tok 
how many pikin die
for inside and outside IDP camp 
for only last year.

There is fire on the mountain. 
If anybody run go Mountain of Fire, 
abeg help me ask 
why e be like sey na we
be de ten thousand 
falling at the side.

Seun Lari-Williams was born in 1987. He attended Badagry Grammar School and studied law at the University of Lagos where he served as President of the Law Society. His first anthology Garri for Breakfast was longlisted for the 2017 NLNG Prize for Literature.

No comments:

Post a Comment

The Celebrants, a poem by Ken Saro-Wiwa

The Celebrants They are met once again To beat drums of confusion Tattooes of mediocrity They are met once again The new cow to lead To the ...