Sunday 6 February 2022

Money Ritual

Money Ritual
by Seun Lari-Williams

E get one land like dat 
wey dem dey commot person head
like sey na goat, 
on top sey dem believe sey e
fit turn bank note. 
I no dey sugarcoat.

Dis land wey I dey tok, 
dem dey harvest human being 
like sey na yam
on top sey dem wan to bam, 
dem wan kee cow and ram. 
I dey tok as I see am.

Wetin go surprise you be sey 
na still dis land be 
poverty capital of the 
whole world, 
Na their footprint na im 
plenty pass on top Sahara sand, 
na still dem dey swim 
Mediterranean sea pass, 
Na still their pikin dey do 
ashewo pass for Italy 
and Austria. 
Na still dem ordinary mosquito
dey kill pass.

Juju dey work na im 
dem carry dem forefathers dem 
enter boat. 
For four hundred years, 
dem use dog chain 
take hold their papa for throat.
Juju dey work na im ordinary 
mosquito dey kill dem like fly?
Money ritual dey work na im 
we dey suffer, 
dey borrow money up and down, 
money wey pikin wey dem never born 
na im go pay?
Juju wey no fit carry country go front, 
dat one na Juju? 
I no tok again, 
I dey vex.

Seun Lari-Williams was born in 1987. He attended Badagry Grammar School and studied law at the University of Lagos where he served as President of the Law Society. His first anthology Garri for Breakfast was longlisted for the 2017 NLNG Prize for Literature.

The Celebrants, a poem by Ken Saro-Wiwa

The Celebrants They are met once again To beat drums of confusion Tattooes of mediocrity They are met once again The new cow to lead To the ...